SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER
11/01/2016
Morning Dew Of The Word Of God
EVERY PLAN OF MY ENEMY FOR ME TO FAIL WILL FAIL IN JESUS NAME.
Amen.
Our enemies nor be only the pipo wey we follow quarrel wey we cum dey keep malice.
Our enemies nor be only those pipo wey nor like us and dem dey show us.
Anybody wey dey eat with us, play with us and even sleep with us but e dey plan our downfall for back, na our enemies.
Our brothers, sisters, friends and family members wey dey laff with us for front and for back, dem dey kill us. Na still our enemies.
By the blood of Jesus, any plan wey dem dey plan against us to see us suffer, down or cry, this year, that plan go fail in Jesus name.
Amen.
As we dey live our life jeje, we pray their plans nor go near us in Jesus name.
Amen.
We nor come life to suffer.
Anyone wey say na our enjoyment dey pepper their eyes say dem wan make us cry, the Lord shall destroy their plans in Jesus name.
Amen.
Lord Jesus, take your place in our lives.
Fight your battle.
Secure us in all we do in Jesus name.
Amen.
Thank you Lord for answered prayer.
In Jesus name we pray.
Amen.
Amen, let all affliction in every area of Rodica ,Stefan, their life ,children be gone you tumor brain,,with your simtomes be consumed by fire of God from RODICA AS WELL ANY HEPATITIS C, DIABET FROM STEFAN,,ANY ATACKS AGAINST ME AND MY LOVE ONE LORD LET BE FOREVER UNDER CONTINUE DESTRUCTION,,,,,LET YOUR MERCY FAVOR and GRACE SPEAK FOR THEM IN NAME OF JESUS THANK YOU LORD FOR YOUR ANOINTING AND ANSWERS, IN NAME OF JESUS CHRIST